Di place wey dis thing dey na Thailand and dem know di place as Naga cave because of him creepy look. E looks exactly like head and body of a giant snake.
di body of di cave looks like e get scales ontop and di elongated part clearly looks like snake head
Dem say na part of newly discovered cave wey dey for Bueng Khong Long, Thailand. Di locals name am “naga cave”.
Di word Naga in Sanskirt language means snake or serpent.
For Hinduism, Buddhism and Jainism, di Naga or Nagi dey divine, semi-divine deities, or semi-divine race of half-human half-serpent beings wey occasionally take human form.
SEE VIDEO
SEE MORE FOTO
Meanwhile, to stop di spread of coronavirus for Kano, di State Government on Wednesday suspend all traditional festivities for di forthcoming celebration.
Di gathering for Hawan Daushe - di paying of visit on di Governor by Emirs and massing of Emirs at Shettima House, among other traditional outings by di Emirates don dey suspended.
Commissioner for Information, Muhammad Garba, tell reporters say di decision na part of government’s efforts to consolidate on di successes wey dem don achieve as regards di fight against Covid-9.
Eid-el-Kabir na di holiest festival for Muslims’ to honour di willingness of Prophet Ibrahim to sacrifice him son, Isma’il as an act of submission to God’s command, before God stopped am and inform am say no need. Him sacrifice don do.
Garba say di suspension of di Sallah’s festivities na after serious discussion by members of di State Executive Council (SEC).
He said di Excos however grant dem to conduct Eid-de-Kabir congregational prayers across di state under strict observance of social distancing and other COVID-19 safety orders for praying grounds.
He announce say di State Government go assist to provide safety materials, such as face masks and hand sanitisers.